Pages

Friday 2 May 2014

black wahala


Blackberry don chop my money tire, na im I come vex yestaday sell am, come take some money buy China phone!
Now am in bigger trouble!!!
1. E go full after 3 minutes of charging.
...
2. The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Firelighter etc.
3. I fit write Text message with a toothpick sef.
4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-porn, samswag etc.
5. When aeroplane pass e go record "One missed Call".
6. When a big truck horn; e go show "Charger connected".
7. When Chinese man pass e go show: "One Bluetooth device found".
8. When fine gal waka pass, e go show "Ur favourite food found".
9. When ugly gal waka pass, e go show, "Virus detected".
Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo?
Even as I dey find buyer, e dey show me for screen:
no contact found

No comments:

Post a Comment